Crypto Trading Now Legal In Nigeria – CBN

Nigeria’s central bank (CBN) don finally commot the ban wey dem been place on crypto trading!

Dis one dey come as various global sectors dey reason to regulate the way these cryptocurrencies dey work.

Remember say CBN bin ban banks from doing anything wey concern crypto trading for Feb. 2021, because of money laundering and terrorism wahala wey dem dey use crypto do, according to CBN.

But from the new circular, Dec 22, the CBN don yarn say current trends globally show say need dey to regulate crypto activities.

Dis na better News for Nigeria, however, even when dem been ban crypto dealings with banks, Nigerians still continue to trade crypto as them remain the first for d African global crypto adoption.

More News loading……….

Leave a Comment