Why Coinbase go fit relist XRP

Spread the love

Based on how di Ripple Vs. SEC court case dey go, coinbase fit relist XRP according to dia exchange’s chief legal officer, Paul Grewal. Say na di ruling on di case go determine how di exchange go talk relate with di token.

Paul Grewal follow Tony Edwards talk recently for di “Thinking Crypto” podcast. For di talk em yarn say beta possibility dey sey coinbase go  relist XRP. But nobody know when di court ruling go happen, and wetin di go be di outcome, as em yarn say di decision to relist XRP go dey based on some kind factors.

 

Coinbase go relist XRP?

Di court and Ripple don battle for over two years and as di US regulators dey fight against XRP’s status as a security, Ripple don near to comot em digital asset from the case.

As di gbese don dey come to an end, chances dey sey coinbase go relist XRP, judging from wetin coinbase chief legal officer Paul Grewal talk during em time with Tony Edwards on di Thinking Crypto podcast wia em breakdown di possibilities.

Grewal come explain give say di relisting of XRP depended on two tins, di first na di grounds of di ruling and di second na di reasons wey di judge give. Em still come add say coinbase go still check if court go agree with di relisting decision.

“Plenti tins go depend on di particulars of dat court rules, I know sey e no go satisfy some, but we get responsibly as a publicy listed company to dey careful in dis area and with mata wey concern any token wey be subject of federal court litigation.” Grewal yarn.

Trading of XRP bin dey suspended since January 2021 for coinbase as di filling of di SEC lawsuit happen, and as dos legal proceedings don dey reach em end, Ripple community just dey look to see how exchange’s go take respond to di positive ruling wey go happen in favor of Ripple.

 

Leave a Comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *