New gbese don happen on top the FTX gbese, dey don sue YouTubers wey promote FTX in a new class action lawsuits, dis suit dey claim $1 billion in damages from di connection wey di YouTubers bin get with di collapsed crypto exchange, FTX.
🚨BREAKING: Youtubers promoting FTX are being sued in a class action lawsuit. Claiming $1 billion in damages. 😬💀 pic.twitter.com/n2rg4k302P
— Coffeezilla (@coffeebreak_YT) March 16, 2023
FTX collapse don raise plenti lawsuits since the mata start till now, come join dis latest lawsuit wey be like di one wey reach all di celebrities wey endorse FTX before em go bankrupt last year November.
Why dem sue YouTubers wey Promote FTX
Dey fit no get any wahala in the history of digital asset industry wey reach or go fit pass dis FTX collapse as di mata don shake do entire industry like earthquake, company wey everi other company bin dey respect turn to di centre of wahala as plenti fruads come surface and millions of dia clients no fit get access to dia moni.
The Block don yarn say YouTubers wey promote FTX don dey sued inside a new class action lawsuits, specifically, the report “accused several influencers of promoting FTX and den scrubbing dia channel of clips sey dem endorse di exchange wey don collapse.”
Di lawsuit dey around di promotion of di exchange by diz influencers, say dia endorsement bin come “without disclosing di nature of any payment or compensation.” And di persons wey Dem don sue for now na BitBoy Ben Armstrong, Erika Kullberg, and “Meet Kelvin” Kelvin Paffrath.
Adam Moskowitz of di Moskowitz Law firm dey represent di plaintiff inside dis case. Moskowitz bin also dey involved for di lawsuit against Tom Brady and oda celebrities wey bin promote FTX become em crash.