EU Council don agree to EU digital wallet

Spread the love

Di aim of di European Digital Identity framework wey dem introduce for 2021 na to enable and protect di digital identity of EU citizens.

Di European Parliament on March 15 bin vote in favor of negotiating a mandate to follow EU member states talk on di revision of di new European Digital Identity (eID) framework, based on the announcement. Di plenary vote come result to 418 votes in favor and 103 votes wey dey against di idea, come get 24 parliament members wey bin no follow vote.

Di aim of dis EU digital wallet

As the mata don get plenary’s endorsement, di EU council don ready to start discussion on di final form of di legislation, lawmakers don talk say, parliament’s stand for dis negotiation go be based on di amendments wey di Industry, Research and Energy Committee (ITRE) bin don adopt for February.

As dem bin don report, ITRE still add di standard of zero-knowledge proofs inside em eID amendments, wey go allow EU citizens get complete control of dia identity data.

Di scheme go allow citizens to identify and authenticate demselves online = via a  European digital identity wallet = wey no need to resort to commercial providers, as di case today – a practice wey don raise trust, security and privacy concerns.” the European parliament talk.

Di eID legislative proposal wey Dem carry come for June 2021 aim na to create “European Digital Identity” still come add a special digital wallet wey na citizens and businesses inside di EU go dey use am. Di “European Digital Identity Wallet,” wey dem still know as EDIW, wan allow people and companies inside di EU to store Identity data like addresses and names still store oda tins like digitized documents, including data wey dey bank accounts, birth certificate, diplomas and oda documents wey go dey useful for cross border.

Leave a Comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *